Stabolcoins
Digital money wey yu fit yus evryday
Stabolcoins na coins wey dey built ontop Ethereum, wey dem design make dem dey one fixed price, even if de price of ETH shange dem nor go shange price.

Why stabolcoins?
Stabolcoins na cryptocurrencies wey nor dey fluntuate. Dem shia plenti same powers as ETH, but dia value dey stabol, e be like traditional currency. So yu go get asess to money wey dey stabol wey yu fit yus for Ethereum. Hau stabolcoins dey take get dem stabol price
Stabolcoins dey global, and dem fit send am ova di intanet. Dem izy to risiv abi send wons yu get Ethereum akant.
Dimand for stabolcoins dey high, so yu fit earn interest if yu lend yors. Make sure say yu sabi di risks bifor yu lend.
Dimand for stabolcoins dey high, so yu fit earn interest if yu lend yors. Make sure sey yu sabi di risks bifor yu lend.
Stabolcoins dey sikure by cryptography. Norbody fit forge transakshons on yor behalf.
Di Bitcoin pizza wey nor popula
For 2010, one pesin buy 2 pizza for 10,000 bitcoin. For dat taim, di 10,000 worth ~$41 USD. For tuday's market, e dey worth millions of dollars. E get plenti similar transakshons wey pipol rigret for Ethereum's history too. Stabolcoins find solushon to all dis palava, wit stabolcoins yu go fit chop yor pizza and hold yor ETH witout regreting anytin later.
Look for one stabolcoin
E reach hundreds of stabolcoins wey dey afailabol. Here na some wey go fit helep yu start. If yu bi biginna for Ethereum, wi go rekomend make yu do some risearsh first.
Editors' choices
For nau, dis ones probably be di eksampols of stabolcoins wey dem sabi wella and di coins wi don find yusful as wi dey yus dapps.
Dai
Dai fit bi di decentralize stabolcoin wey popula pass. E value na like one dollar and dem dey asept am well well for dapps.

USDC
USDC na probably di fiat-backed stabolcoin wey popula pass. Im value na like one dollar and e dey backed by Cirkol and Coinbase.

Top stabolcoins by market kapitalizashon
Market kapitalizashon na di total numba of tokens wey dey exist multiplied by di value per token. Dis list dey shange and di projects wey dem list here nor mean sey di ethereum.org team go endorse dem.
Currency | Kapitalizashon for market | Type for kollateral | ↗ |
---|---|---|---|
![]() | $98,730,445,435 | Fiat | Go to Tether(opens in a new tab) |
![]() | $28,870,969,833 | Fiat | Go to USDC(opens in a new tab) |
![]() | $5,014,800,323 | Crypto | Go to Dai(opens in a new tab) |
![]() | $1,289,986,442 | Fiat | Go to TrueUSD(opens in a new tab) |
![]() | $646,584,148 | Algorithmic | Go to Frax(opens in a new tab) |
Hau to take get stabolcoins
Wetin yu go nid
Yu go nid wallet to give authorizashon for di swap and to store yor coins
To pay for di swap
Update from editor
Get one wallet wey go alow yu buy ETH and swap am for oda coins, even stabolcoins, directly.
Look for walletDapps wey yu fit yus to swap yor coins
If yu nor get ETH and one wallet already, yu fit yus dis dapps ekschange am for stabolcoins. More informashon on top desentralize ekshanges
Wetin yu go nid
Akant for one ekshange abi one wallet wey yu fit buy crypto from directly. Yu fit don yus one bifor to get some ETH. Shek make yu si wich savis yu fit yus for wia yu dey live.
Shek di savis wey yu fit yus for wia yu dey live
Wetin yu go nid
Stabolcoins na good way to risiv payment for work and savis bikos di value na stabol. But yu go nid wallet to fit kolet yor payment.
Yu go nid wallet to kolet die stabolcoins wey yu don chop
Wia yu fit chop stabolcoins
Na platfoms wey go pay yu for yor work as yu dey yus stabolcoins.



Wetin yu go nid
To borow stabolcoins, yu go nid yus di koret dapp. Yu go also nid wallet and some ETH.
Yu go nid wallet to yus one dapp
Yu go nid ETH for kolateral and/or transakshon moni
Kolateral for crypto
Wit Ethereum, yu fit borow directly from oda pipol witout say yu go nid to trade yor ETH. Dis one fit give yu leverage – some pipol dey do dis to try gada more ETH. More tori on stabolcoins wey crypto dey bak
But bikos di price of ETH dey shange anyhau, yu go nid put more kolateral. E mean say if yu wont borow 100 stabolcoins, yu fit nid like $150 worth of ETH. Dis one dey protet di system and di pipol wey lend yu.
Places wey yu fit borow stabolcoins
Dis dapps fit alow yu borow stabolcoins wey yu go yus crypto as kolateral. Some of dem fit asept oda coins apart from ETH.
Risks
If yu yus ETH as kolateral and im value drop, yor kolateral nor go fit kova di stabolcoins wey yu generate. E fit kause yor ETH to drop finish and yu fit fase penalty. So if yu borow stabolcoins, yu go nid dey monitor di ETH price. Kurent ETH price
Save wit stabolcoins
Stabolcoins dey mostly get interest rate wey dey above averaj evrytaim bikos many pipol dey dimand to borow dem. Some dapps dey wey yu fit yus yor stabolcoins earn interest by putting yor coins inside one place wey pipol go fit borow am, and you go dey earn interest for yor stabolcoins instanta as you deposit dem inside the place. Just like hau e dey for banks, yu dey supply coins for pipol wey wont borow but yu fit withdraw yor coins and yor interest at any taim wey yu wont.
Intrest-earnin for dapps
Put yor stabolcoin savings for good yus to take earn some interest. Just like hau evrytin dey for crypto, the predicted Annual Percentage Yields (APY) (which means: hau much yu go dey earn wit yor coins per year) fit shange day-to-day based on the real-time supply and dimand.
0.05%
Di averaj rate wey banks dey pay for basik, federally insured savings accounts, for USA. Source(opens in a new tab)Hau dem dey work: types of stabolcoin
Always do yor own risearsh
Algorithmic stablecoins are experimental technology. You should be aware of the risks before using them.Backed by fiat
Pros
- E dey safe against crypto price flunctuashon.
- Shangis for price nor dey too much.
Cons
- Sentralized - sombody supose issue di tokens.
- E dey rikwaya to dey audit to make sure sey di kompany get enuf risav.
Project example
Wey crypto dey back
Metals wey dey preshios
Algorithmic
Find plenty tori about stabolcoins
Dashboard & Education
- Goto Stablecoins.wtf website(opens in a new tab)Stablecoins.wtfStabolcoins.wtf offa one dashboard wey get historical market data, statistics, and edukashonal kontent for dem most prominent stabolcoins.